What I Have Been Up To - Ziggy
Who missed me? Been gone for a while and some people wondered wetin do me....well I never shut down amebor ministry, and NO NO i wasn't kidnapped. I was kinda busy writing my Post Grad exams...and people of God...It wasn't beans and ekpa.
One of the paper I been write ehhh, I dey look the paper, the paper dey soji me back. But God pass dem sha. Aside the exam ish, one baybee just pump my BP last week wen she yarn me say "Ziggy I Am Pregnant". Choi as she talk am ehhhn, I just realize say Pampers dey cost oh.
I come finally zero my mind say na so I go come be like Tubaba. One early morning wen I call the babe she come dey sound somehow...me playing caring guy come ask am say wetin dey happen na....the babe using sleep eye no know when she tell me "I'm having menstrual pains". Me just taya.... Shuuu? Menstrual pain on top belle again? Thunder fire the pant wey you hang for outside...
Still on the matter, Ziggy is back on the gossip things...Una sabi as e dey be...
Updated: I dey always tire rubber ohhhhhh....ALWAYS
Advertisement
Advertisement
Tweet
Missed ya o! But take it easy on d ladies o. Abstinence is d best o
Glad 2 have u back. Guy make u sef d try wear raincoat naa
Welcome bak Ziggy. Alwayz use protection with ur babe b4 u go carry gbese.
Welcm back bro missed ya so much like d way ℓ̊ missed ma x.......lolz
Welcm back Ziggy we missed ur gist joor
- Tonto Dikeh and Mikel Obi Secret Wedding? Photo
2012-02-26 - Watch Video of Four Uniport Students Killed and Burnt For Allegedly Stealing Laptops
2012-10-07 - Wizkid Arrested For Drugs?
2011-03-29 - Video Mix: My Oga At The Top - Dj Ziggy ft NSCDC
2013-03-14 - JAMB Releases 2012 Results. Only Three Scores Above 300
2012-03-30
Welcome back.